Skip to main content

Posts

Showing posts with the label mymicradiary

MyMicraDiary#

  Micra hit your car, you dey form Americana.. e be like say this woman na JJC for Ibadan.. she never learn how Ibadan women dey handle car bashing... Dem go first remove their shoe (most don't even drive with shoes anyway).. after that they will run out of the car very seriously towards the person that bashed them as if they'll cause some havoc, na lie o.. then they will start struggling with their phone either to call someone or to want to take picture of the plate number.. then they will stand in front of the car shouting, claiming all the rights wey no even dey road safety manual... This woman still dey there speaking fone.. issokay! Madam you go need spice this your Americana fone with small craze ni o.. na combo fit do am o.

MyMicraDiary

  Me today: ogbeni no go think am o.. for here! I go treat your f_up today.. you know who I be? My Mind: God! Pls no let this boy kill us today.. which kind wahala him dey go find now.. who we be now! God, Pls make the shakara work o.. else make them no beat us for here today! Omo, I survived today.. cos if the driver no dey scared by my shakara lasan and he descends on me.. Hmmm, but thank God the shakara worked... Untop right of passage o.. the Micra driver self know say he was wrong but him wan use ogboju for me.. na so meself shakara am! We go again any other day! Abi? My mind right now: no try am again o!